Thursday, 9 May 2024

GBA-GBOS LIVE NO DUPLICATE! CROSSING THE RED LINE.

JOHNSON: Emm, Patrick! Patrick!, wetin happen, wey you dey run with Ghana must go like antelope wey Wolf dey pursue?

PATRICK: My guy, this one even pass antelope wey Wolf dey pursue O.
He don red for my side O.
He get one of my friend, wey he borrowed 2.6 million naira from money lender and na me stand surety for am.
Dem warm me say if he nor pay the money or if anything happen to am, the second day naim l go pay the money.
Na the agreement be that.

Yesterday, naim the guy come die. Now, wey dem never hear so, make l kuku run for my dear life.
I know say dem never know.

JOHNSON: Na where you come dey run go so?

PATRICK: My guy, honestly, me myself l never know.
I  go first run enter bush.
I go come find my way to either Cameroon or Niger Republic or Benin Republic or  even Tongo. Because if dem catch me, my guy, na Oko prison for Edo state straight O.

No comments:

Post a Comment