Thursday, 14 March 2024

GBA-GBOS LIVE!

                           BEFORE AND NOW!

                                 BEFORE

JAGUDA: This woman, make l tell you. I nor dey fear prison O.  This one wey dem released me so, na the 5th time wey l don go prison. I fit kill person now, now, O. The food wey dem dey give us for prison far better pass the suffer wey l dey here so.

If una tell me nonsense now, l fit kill person make l go back to meet my friends there. I like the prison pass here wey l dey suffer so. I nor know who tell dem to release us O.

                                    NOW

JAGUDA: This woman, make l tell you. If dem send you come meet me, tell dem say you nor see me O.
This one wey God touch their mind to release us from prison so, l don become a born again.
I nor want to go back to that prison again O.

Hunger and suffer want to kill man pinkin. Na one seed of rice dem dey give us. See as all my ribs don dey show.
Nothing go make me go back to that prison again O.
See the wey hungry dey beat people die every day.
God forbid. No more crime O.

No comments:

Post a Comment