Thursday, 28 March 2024

GBA-GBOS LIVE! He who sows wind, reaps whirlwind!

                             PAST AND PRESENT.

                                            PAST
MOTHER: My pinkin, this na laptop wey l buy for you to do Yahoo. Na my cassava farm naim l sell take get money to buy am.

SON: Thank you mama. No worry, l go buy motor for you when l don pick. Before some months, maga go pay.

                                         PRESENT

MOTHER: My pinkin, this nah laptop. I know say you go need am. Naim Joseph use take buy motor for him wife and papa so.

SON: Mama, we nor dey use laptop again.
If you want to helep me, put yourself down for me to use.
We don upgrade to Yahoo plus.
The Joseph wey you dey talk so, you see him mama?
No be her he used.

MOTHER: He be like say nah dat mat dem go take bury you prematurely. If l use this my belle wey l take conceived you and the breasts wey l take feed you, curse you, nah madness one time, idiot.

No comments:

Post a Comment