Recently, a community decided to cut off from the electricity distribution company's light. They started to cut off their cable wires. When the NEPA officials heard about it, they rushed down. They began to beg the people.
NEPA OFFICIALS: Please, please! Don't do that.
We know say we don fuckup. We beg una. Nor be small money we dey get from this place.
Make una nor comot una cables.
Na food una want to comot from our mouth so.
COMMUNITY: So una still dey beg?
Na devil catch una today.
Una never see anything O.
When una don collect money finish, una go dey drink beer with our money, come dey cut people light anyhow.
We go burn the cable sell them to copper wire buyers.
NEPA OFFICIALS: Make una think again O.
We be una friend and customers O.
COMMUNITY: Which friend, una be?
Police wey say be our friend don help us before?
Who friend help?
Make una disappear before we burst bottle for una corrupt head.
Yeye dey smell.
No comments:
Post a Comment