Sunday 21 April 2024

GBA-GBOS LIVE NO DUPLICATE! Alcohol in action!

Ogogoro is doing a perfect job in the brain of this man.

MAN: SO you this useless ashawo woman brought a man directly into my bed to make love. Two of una don die today.
Em, Alice, Alfred, patience and Mary, oya,  make una bring my cutlass quick quick. Una mama go die today with dis  him lover. As she say she nor dey shame so, l go tell am say na me marry am. See the way she bring man come my bed come sleep this afternoon.

I say where the cutlass? Abi una dey craze?

CHILDREN: Daddy, what is the problem?

MAN: Una dey craze? Abi na who una dey ask say wetin?
Una blind? Una nor see una mama inside bed with one of her lovers?

CHILDREN: But daddy, those are the two dummies mummy bought this morning. She wants to take them to her shop.

MAN: Ehen, so na dummy? I tink say na your mama and her lover. Okay, why una nor go school?

CHILDREN: But daddy, we are on holiday.

MAN: Where the ogogoro bottle wey dey under the table?

CHILDREN: Daddy, look at it on your hand.

MAN: No, no! I nor go allow this. Who among you took away my room? Where are my chairs, tables and bed? Why has it become this small? Make una tell me now, now or I go kill person O.

CHILDREN: But daddy, you are in the fowl's cage, not your room. Look at your room here, you mistakenly entered into mummy's fowl's cage. Thank God that the big male cock is not inside.

MAN: Wetin you mean say the male cock nor dey inside?
Wetin he for do me? I nor get hand? As he get hand, na so me self get hand. We go fight die for here. If he carry wood,  me self go carry wood. If he carry bottle, me self go carry bottle. If he shook me with knife, l go shook am with knife. Nonsense.


No comments:

Post a Comment