Thursday 4 May 2023

2022 FLOODS FEVER.

The following ensued in one of the IDPS camps that accommodated the flooding victims.
JUDGE: You should know that I am a judge and so you must address me "your lordship"  

MAN: Oga judge, that one nor go fit work here O.
This na ghetto naim  we dey so and things like your lordship nor dey work here.
Na me be the chairmo of this area, The name wey we dey  use here na "bros'" For you, na senior bros you go call me, you hear me, abi.
Why you nor tell the floods wey carry your court and your yeye hammer say make he respect you?
Look, na IDP camp we dey here so, nor be your court.
If you nor go blow fire for the oil rice wey dey fire so,   na hunger go baptize your intestines to give you ulcer.

We all here na equal. Go vex for the mammy water wey don take over your chamber under water. If you do any how here, you go see any how O.

No comments:

Post a Comment