FEBRUARY 27TH, 2023.
CUSTOMERS: I beg, Oga, na from riverine area we come from. Na we dey cook local kerosene and diesel for inside the creeks. Na money we carry come.
BANK OFFICIALS: Una nor hear say government talk am since say make everybody carry him money go bank?
Anyways, how much una bring?
CUSTOMERS: Na only ten million naira.
BANK OFFICIALS: Una really dey make money for the creeks O. Wetin dey there now be say, the money don expire. And if EFCC cash una with this money now, na jail straight una dey go be dat.
CUSTOMERS: Please, Oga, make una helep us. Na for years now, we don't dey save this money.
BANK OFFICIALS: We nor go report una. We go helep una. But wetin go dey there be say, na fifty, fifty. We go take five million naira and una go take five million naira. If una know other people wey still get money like this, make una tell dem say make dem nor fear, make dem bring dem, we go helep them.
CUSTOMERS: He good like dat. So far, make everything nor loss.
Later, this policy of the CBN na blessing for us the bankers O. See as cool five million naira just waka enter our hand just now. And we know say other ones go still come O.
No comments:
Post a Comment