Monday 25 March 2024

GBA-GBOS LIVE! ( Urban and rural )

               WAYO RISK BUSINESS, NOR GOOD O!

                      Two women were discussing.

SHADADA:  O girl, no play with me O. 
Na small small wayo risk business, naim l dey take dey chop for this township O.
Na six compound, l don stay for this city. Na now, l want to pack go village so.  l don really enjoy sha O. 

Anytime l want to play wayo, l go just shout say dem to broke my room thief my money. I go call the amount high. Come see as people go come dey sorry for me. Before you know wetin dey happen, men don dey donate money for me.

 Landlord go come say make l nor pay rent for that month. This one wey l dey go village so, all those bush men wey be local champions go take their eyes see oba.

                        SHADADA IN THE VILLAGE

SMALL PINKIN WEY NOR KNOW HIM MAMA LOVER NAIM, DEY CALL AM, UNCLE.

SHADADA:  Make una come O! Make una come O!!
Dem don broke into my room thief my money. The money plenty well well O. Make una helep me OO.

LANDLORD: My daughter, nor worry. Dem nor dey thief for this my compound. Dem never born the person. Na just seven alligator pepper. The person go crow like cock.
Make l go bring my Ogbulagha, "the terminator"

And make you go check the room again because if na your own mistake, "OGBULAGHA THE TERMINATOR" aka MOBILE COURT, INSTANT JUDGEMENT " nor go spare you O. Make the person wey thief the money go buy him own coffin ready wey them go take bury am now.

SHADADA:  Baba landlord, you mean say the person go die within seven days?

LANDLORD: Not only die, him body go swell up like the body of elephant wey don rotten.

SHADADA: Baba landlord, l am a Christian and l won't want my enemy to die.

Baba landlord: My daughter, this is not the case of church matter but to stop nonsense. Just wait seven days time and see.

SHADADA IN THOUGHT: Dem nor dey really play wayo for wayo house O. Na so l go come die. I go take shame comot make l tell am say money nor lost O. Dem say if you shame, you go die O. The business don already be bad market.


UP! UP! OGBULAGHA aka the TERMINATOR, mobile court, instant judgement. 

Village nor dey take nonsense O!

No comments:

Post a Comment